Hamas hostages: Who be di pipo dem take from Israel?
11 October 2023New Informate 6 November 2023
Israeli military say na more dan 200 pipo Hamas hold hostage.
Dem don release five hostages. Ori Megidish, wey be Israeli solider, dem free am during di operation for Gaza on 29 October. Two women, Nurit Cooper and Yocheved Lifschitz, regain freedom on Monday 24 October. On Friday 20 October, two US hostages - a mother and daughter - also dey freed.
Hamas say dem don hide di hostages in "safe places and tunnels" within Gaza. Israel Defense Forces (IDF) bin sday di hostages include 20 children and between 10 and 20 over-60s.
IDF don notify some families say dem dey hold dia loved ones hostage, while oda families - wey dia relatives remain unaccounted for - believe say dem take dem.
Dis na di stories of hostages wey dem take from Israel on 7 October wey don either dey confirmed by di BBC or dey credibly reported.

Rimon Buchshtab Kirsht, 36, Daniele Alony Mevneh, 44, and Lena Trupanov, 50, appear for video wey Hamas release on 30 October.
Daniele Alony Mevneh wey dem hold hostage wit im pikin Amelia Mevneh, five year-old; Daniele sister Sharon Alony Cunio, 34, and im husband David Cunio, 33, and dia three-year-old twin daughters Emma and Julie. Dem kidnap dem from kibbutz for southern Israel, Sharon and Daniele brother Moran tell CNN. Moran tok say e na witness inform am say dem don carry di family go shelter inside safe room but Hamas don set fire for di house - Hamas kidnap afta dem try to escape di fire.
Elma Avraham, 84, don live for Nahal Oz kibbutz for nearly 50 years bifor dem kidnap am, a tok-tok pesin for di community tok. Di tok-tok pesin add Hamas film am as dem dey carry am dey go.

Keith Seigel, 64, and his wife Adrienne - often known as Aviva - Seigel, 62 wdem kidnap dem from dia house for Kibbutz Kfar Aza, Keith brother Lee Seigel tell BBC.
Amiram Cooper 85, and his wife Nurit, 80 dey taken from dia home for Kibbutz Nir Oz, one kibbutz for southern Israel close to Gaza, dia daughter-in-law Noa tell BBC. Di family last speak to di couple during di Hamas attack, Noa say, wen di couple bin dey dia safe room. Di family later trace Amiram phone to Gaza. On Monday 23 October, Nurit na one of two women dem release.

Oded Lifshitz, 83, and his wife Yocheved, 85 dey taken hostage from Kibbutz Nir Oz. On Monday 23 October, Yocheved na one of two elderly women wey dem free. After hearing di news of her mama release, dia daughter Sharone - wey be London-based artist - say: "While I no fit put into words di relief say she now dey safe, I go remain focused on securing di release of my father and all those - some 200 innocent pipo - wey remain hostages for Gaza."
Ohad Munder-Zichri, 9, im mother, Keren Munder, 54, and im grandparents Ruthi and Avraham Munder, both 78, dey kidnapped from Kibbutz Nir Oz, Israeli officials tok. Di Associated Press report say dem trace a phone signal to Gaza.
Clara Marman, 62, her partner Louis Har, her siblings Fernando Simon Marman and Gabriela Leimberg, and Gabriela's teenage daughter Mia Leimberg dey believed say dem take dem from Kibbutz Nir Yitzhak. Di group of five Argentinian-Israelis bin dey hide for dia safe room, according to Louis Har daughter wey bin dey text with am. Di last message enta by 11:04, di Times of Israel report. Clara daughter Maayan Sigal-Koren say Israeli army tell dem say dem track dia phones to Gaza, according to Vatican News.
Sharon Alony Cunio, 34, her husband David Cunio, 33, and their three-year-old twin daughters Emma and Julie; Sharon sister Daniele Alony Mevneh and her daughter Amelia Mevneh, five, dey kidnapped from one kibbutz for southern Israel, Sharon and Daniele brother Moran tell CNN. Moran say one witness tell am say di family bin take shelter inside a safe room but Hamas come set fire to di house - dem take dem hostage after dem leave to escape di flames.

Dafna Garcovich and im husband Ivan Illarramendi Saizar - wey be Israeli-Chilean and Spanish citizens - Hamas kidnap dem from dia homes, Dafna father tok. On 19 October, di Israeli Foreign Ministry tok say di couple dey for hostage for Gaza.
Margalit Mozes, 78 wey we see for video clip as Hamas dey kidnap am from im home for Nir Oz, im brother Chanon Cohen tell CBS. She get health problems wey require constant medical care, her family tok.
Eitan Yahalomi, 12, wey Hamas kidnap commot from Kibbutz Nir Oz, and im mama Bat-Sheva and two sisters. Bat-Sheva, wey be French national, tell tori pipo say she manage escape wit im daughters but she no fit find Eitan as dem dey drive to Gaza for safety. Dem shoot and injure Ohad, wey be Bat-Sheva husband, as im dey try defend im family and dia house, dem still neva find am.
Judith Weinstein Haggai, 70, and husband Gad, 73, dem dey find dem for Nir Oz afta Hamas attack. Di Israeli military don confirm to di family say dem don kidnap dem, according to CTV News in Canada.
Adina Moshe, 72, wey family identify for video clip wey show am between two Hamas fighters ontop motorbike, as dem dey carry am to Gaza. Dem don kidnapp am from Nir Oz, im relatives tell CNN.
Alex Danzig, 75, one scholar and historian of di Holocaust, dey im house for Nir Oz, wen Hamas attack am on 7 October. "We know for sure say dem kidnap am," im son Mati tell BBC. Alex - na Holocaust survivor - e don spend di last 30 years as he dey work for Yad Vashem. Im disappearance don trigger campaign for im release, for Israel and for Poland.

Hagar Brodutch, 40, im daughter Ofri, 10, and sons Yuval, 8, and Oria, 4, wey dey live for Kfar Aza, near di border kibbutz wit Gaza, wen Hamas attack, according to Avichai Brodutch, Hagar husband and im pikin papa. E tell ABC News say e bin tink say dem don die - but e don receive message from di kibbutz say dem don see dem alive
Doron, Raz and Aviv Asher wey dem carry captive wen im dey stay wit im relatives near di Gaza border. Yoni, husband see video of im wife and children, wey bin 5 and 3year old, as dem dey load dem inside wit oda hostages. E don trace her mobile phone to Gaza.

Meirav Tal, im partner Yair Yaakov, and children Yagil, 12, and Or, 16, dem dey among di list of hostages. Di children mama, Ranana, dey on phone wit dem wen Hamas land, as she dey hear di youngest son dey cry: "No take me, I dey too young!" One video show Yair and Meirav wit dia captors.

Amit Shani, 16, wey Hamas militants dem order into car afta dem forcefully break into di family safe room for Kibbutz Be'eri, im mother tell di New York Times.
Tsachi Idan, wey im wife Gali, see last as Hamas militants dey carry am go. Dia family bin dey ambushed for dia safe room for Kibbutz Nahal Oz.

Ron Scherman, a 19-year-old Israeli soldier, dem kidnap for crossing border, im mama Maayan tell Israel i24 news channel. She later identify am inside video wey Hamas post, she tok.
Shiri, Yarden, Ariel and Kfir Bibas dem kidnap dem kibbutz for southern Israel wia dem dey live and wia Shiri be kindergarten teacher. Shiri dey hold Ariel, age 3, and 9-month-old Kfir for foto as Hamas militants surround dem.

Yossi and Margit Silberman, Shiri mama and papa, dey among pipo wey dey miss.
Daphna Elyakim, 15, and im sister Ella, 8, wey dem see for video as dem capture am for dia house, Nahal Oz kibbutz, relatives tok. Dia papa Noam Elyakim, Noam partner Dikla Arava, and im 17-year-old son Tomer wey dem kill. Relatives tok say Ella and Daphna don appear for foto wey Hamas post.
Karina Ariev, 19-year-old soldier, wey bin dey serve for army base near Gaza wen dem kidnap am. Im sister Alexandra tell BBC say she bin hear shooting as Karina dey call am during di attack.

Ofer, Erez and Sahar Kalderon na prisoner for Kibbutz Nir Oz. One video on social media show 12-year-old Erez wey dem carry go Gaza, one relative Ido Dan tell BBC. Two relatives, 80-year-old Carmela Dan and im granddaughter, Noya, 12, pipo believe say dem don kidnap dem but Israeli authorities tok say dem don see dia dead body.

Mia Shem, 21, from Shoham, appear inside di video wey Hamas release, dem tok say dem kipnap am from party. Di Israel Defense Forces confam say dem kidnap am.

Channah Peri, 79, and im son Nadav Popplewell, 51: Channah daughter Ayelet Svatitzky wey bin dey tok to dem on di phone before di gunmen burst in say Hamas take dem hostage. She tok say di militants send foto of im two relatives, wey both get diabetes, wit armed men for di background.
Omri Miran, 46, Omri wife, Lishay Lavi, tok say she see as dem dey carry am go wit handcuffs for hand wit three oda hostages from Nahal Oz kibbutz.
Liri Elbag, 18, bin just start military training as Army lookout near Gaza border wen Hamas attack, her father Eli tell Associated Press. Eli see am inside video wey dey circulated later by Hamas, as e dey crowded with odas for di back of one military truck wey di gunmen seize.
Aviv Atzili and im wife Liat Beinin Atzili, age 49, go missing from dia house for Kibbutz Nir Oz on di day wey dem attack. Dem burn dia house but sign of struggle or blood no dey, according to Di Times of Israel.
Omer Wenkert, 22, restaurant manager, she send message to im family say im dey go safe shelter but dem lose contact wit am, im papa Shai Wenkert tell BBC Today Programme. Shai Wenkert tok say e don see foto of im son for captivity, including foto of handcuff for im hand and e wear only underwear.
Moran Stela Yanai, 40, jewellery designer, dey sell im art work for di festival wen di attack happun. Dem later see am inside video wia she siddon for ground, im brother tell Associated Press.

Evyatar David, 23, dey di festival but fior di morning wey dem attack, im describe say dem run from gunfire bifor dem lose contact wit pipo for outside world, im brother tok. Later, im family say, Evyatar sister post for Instagram as she dey beg for information about im whereabouts - she receive text from unknown number, wey contain video footage of Evyatar with handcuff as im siddon for floor inside one dark room. According to Israel foreign ministry, e dey di hand of Hamas Gaza.
Almog Meir Jan, 21, try to run commot from di festival. Im and im friend manage to drive car commot from di place bifor dem stop am. Almog family say dey don see am for one hostage video.
Inbar Heiman, one student wey be 21, two young Israeli men see as dem dey carry am commot from di festival ontop motorcycle. Hamas don release one video wey show Inbar.
Hersh Goldberg-Polin, 23, from California, dey among pipo wey dem load for truck, im family tell di Los Angeles Times. E don injure and dey unconscious, witnesses tok, and im last phone location show say im dey Gaza border.
Maya Regev, 21, and im brother Itay, 18, from Herzliya dey among pipo wey dem believe say dem kidnap. On di morning of di attack, Maya papa receive call from im daughter wey dey shout "Dad dem wan shoot me, I don die". Di family say dem later see Itay handcuff for di back of di vehicle wey dey inside di video wey Hamas release. Almost two days later, di Israeli army inform di family say dem don kidnap both Maya and Itay.

Shani Louk, one tourist from Germany, wey dem bin tink say dey among di pipo wey dem seize. Im mama, Ricarda, tok say she see video of Shani body afta dem kidnap am. She later tok say dem inform am say Shani dey hospital for Gaza afta head injury. But on 30 October, Ricarda tell German media say di family don get information from Isreali military say she don die afta DNA identification.

Noa Argamani, one Chinese-born Israeli citizen, also dey part of di pipo dem kidnap from di festival.
Video footage - wey her father Yaakov Argamani verify give Israel Channel 12 - show as di 25-year-old dey scream, "No kill me!" as dem carry her away on di back of one militant motorbike.
Bar Kuperstein, 21, tok to im family last on 7 October morning. Later dat day, im family say dem identiy am inside one video of Israeli prisoners, wey Hamas post. Since den, dem say dem neva hear anytin.
Eliya Cohen, 26, and im girlfriend Ziv dey hide from di attack, wen Ziv see say dem don drag am commot and put am for moto as di gunmen dey drive commot, Eliya mama tell di video initiative #BringThemHomeNow. Di family don find foto of of Eliya for Gaza, di Times of Israel tok.
Amit Buskila, 28, from Ashdod, dem hear from am last wen she tok wit her uncle, Shimon, bifor Hamas attack for di festival. Goment don tell di family say dem kidnap am for Gaza.
Vivian Silver, 74, one peace campaigner. Di last time wey she communicate, she tok say dem don attack her house for Kibbutz Be'er.

Roni Eshel, 19, wey dey for army base for Gaza border. Im family say di last time wey dem hear anytin from am, na for di morning of di Hamas attack. Hamas attack im army base. She send text message to im mama around 09:30, she say: "Mama, I dey okay, I dey busy, I love you."

Jordan Roman-Gat, one 36-year-old German-Israeli citizen, dey kidnapped with her husband and young child by Hamas from Be'eri, one kibbutz for southern Israel. She, her husband Alon, and three-year-old Gefen escape wen di car briefly stop, but Jordan become separated from di odas, relatives tell CNN, adding to di fear say dem fit don recapture am.

Camel Gat, 39, na Jordan sister-in-law, wey gunmen kidnap from Kibbutz Be'eri, Haaretz newspaper tok. Dem neva hear anytins from am since den.
Ohad and Ethan Vahalomy bin dey abducted from dia kibbutz, according to Ohad mother, Esther. She say her daughter-in-law and two of her granddaughters manage to escape wen five gunmen burst into dia home, but dem take Ohad and 12-year-old Ethan.
Ditza Heiman, 84, wey neighbour see for Nir Oz kibbutz as Hamas gunmen dey carry am go, na a former social worker, she be di widow of Zvi Shdaimah, wey go UK on di Kindertransport, di organised rescue of children from Nazi-controlled areas during World War Two.

One neighbour bin see as di gunmen drag Dror Or, im wife Yonat, dia son Noam plus dia daughter Alma comot from dia House for Be'eri kibbutz, dia nephew Emmanuel Besorai tok. E neva get any contact wit dem since den, e tok. Noam na 15-year-old and Alma, 13.
Dem kidnap Dr Shoshan Haran, her husband Avshal Haran, daughter Adi Shoham, her partner Tal Shoham and dia children, Naveh and Yahel from dia house for Bari kibbutz, according to di non-profit she establish, Fair Planet.
Fair Planet tok say dem lose contact wit Dr Haran afta di attack by Hamas, but dem track Avshalphone go Gaza and dem believe say di militants don capture di whole family. Avshal na 65, Naveh, eight and Yahel na three-year-old.
Sharon Avigdori, 52, and im daughter Noam, 12, dem bin relatives of Dr Haran and believe bin say dem kidnap dem di same time. Eviatar Kipnis, 65 and im wife Lilach Kipnis, 60, wey dem kill, di family tok. Dem kidnap 85-year-old Yaffa Adar from one kibbutz wey dey close to di border wit Gaza. Her granddaughter Adva bin see one video wey show as dem dey carry her go Gaza, and four armed men surround her.

Di believe na say dem kidnap Ada Sagi, 74, from her house for Nir Oz. Her son, Noam, tok say Israeli soldiers see bloodstains but no sign of im mother and she no dey among those wey dem kill or injure for di small community.

Efrat Katz and Gadi Mozes, di mama of Doron Asher and im partner, dey among pipo wey dem kidnap during di attack on di Nir Oz kibbutz, according to relatives and di Israeli aid agency wia Gadi Mozes work as an agricultural expert.
Sagui Dekel-Chen, one American-Israeli citizen, wey don loss since Hamas attack on di Nir Oz kibbutz, im papa Jonathan tell BBC. Jonathan tok say dem no see im son among di dead body and di "only reasonable explanation" bin say dem don carry am go Gaza.

Joshua Loitu Mollel and Clemence Felix Mtenga, from Tanzania, wey dem kidnap, Israel Foreign Ministry tok. Di two men bin visit Israel on an agricultural internship programme. Mr Mollel papa tell BBC say im son dey study for Kibbutz Nahal Oz.
One video wey Hamas publish show Anucha Angkaew, one Thai national wey bin dey work for one avocado farm for almost two years.
Im wife, Wanida Maarsa, identify am give BBC Thai.
Boonthom Phankhong and Nattawaree "Yo" Moonkan, wey be husband and wife, bin dey work for one mushroom packing factory near Gaza wen Hamas militants burst in and begin fire, according to Thai TV report.
Yo, wey be 35, dey shout as oda pipo dey hide. Dem carry her and her husband, wey be 45-year-old.
One foto show as dem tie O-wat Suriyasri wit im hand for im back as armed Hamas militants dey look, na one of im colleague send di foto to im family, according to Thai TV report.
E get one child wit im wife back for Thailand.
Hamas militants capture Manee Jirachat, wey travel go Israel for work four years ago, plus five oda workers wey dem bin dey hide togeda, according to one Thai TV interview wit im father, wey don follow survivors tok.
Natthaporn Onkaew, Komkrit Chombua, Parinya Taemklang, Pattanayuth Tonsokri, Kiattisak "Top" Patee and one Mr Pongtorn (no first name given), Thai foreign ministry bin name dem as hostages.
Thailand tok say dem capture 14 of dia nationals in total.
Hostages wey regain freedom
Five hostages don dey free. Two Americans - Judith Raanan and im daughter Natalie Raanan - Hamas release dem on Friday 20 October. Two elderly women - Nurit Cooper and Yocheved Lifschitz - get freedom on Monday 23 October. One Israeli soldier - Ori Megidish - regain freedom during ground operations for Gaza on 29 October and e don reunite with im family, di Israel Defence Forces (IDF) tok.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomp1ppp%2BCsn7Wsp6o